#Widget_ID h2 { background: url(Image_URL); height:35px; width: 230px; margin-left: 0px; padding-top:0px; font-family: Sans-serif, Arial, Helvetica; font-size:16px; font-weight:bold; text-transform:uppercase; text-align: center; color:#ffffff; text-shadow:0 1px 0 #fff; }

Friday, February 3, 2012

Enslaved (pidgin version)

Which kain life be this, them born me come this world to suffer? Even the people wey kill jesus sef, God no punish them like this. Hin still have mercy on them.

See as my madam dey treat me, as if i no be human being even their dog (terry) dey mock me. Na so the other day hin enter my roon, carry my clothe from my leather bag go shit ontop, and when i beat am, na so my madam comot dey shout "you wan kill my dog? Useless boy. that witch wey u chop from your village e no fit do me anything. Idiot" as she dey talk, she use her high heel shoe dey hit me for head.

And just this morning as my madam go work, her pikin, samuel, wey i dey call my small oga bring one small girl come house. This girl, i sure say she never reach eighteen years. As i open door i greet my small oga "welcome sir," i no bother to greet hin guest because i feel say na she surpose greet me. I close door to go back go continue with the plate wey i bin dey wash. As i waka pass my small oga, hin call me back com ask me wether i no see hin guest. I tell am say i see her. Hin com ask me why i know greet her, before i go open my mouth answer hin sound me one better slap. I bin dey hear say them dey slap people them dey see star i no belive am until today.

Suwaiba, sam elder sister run commot from her room to come see wetin they happen. She ask her brother why him slap me, na so the guy push her for ground oh. Anti su as i dey call her and my small oga start fight. E no tey, madam enter house come see me wey i dey try seperate fight oh. She come say I wan kill her pikin, she remove her high heel shoe hit me for head na so i come collapse. She no even bother carry me go hospital. Thank God for anti su wey carry me come this hospital i for don die

Now wey i don dey well small small sure say i no go run before my madam come back for me? Abi make i still endure this witch woman? I just dey confused now. This life sef, I tire oh!

1 comment:

  1. Momohslaw has done it again kip it up I luv the pidgin aspect of it

    ReplyDelete

Popular Posts